Na wa oo na only for university enviroment this kine tin dey happen
this tori hapi for one fedral university
for one lodge jealousy wan kill students…u no get u wan fight pesin wey kuku
get. See me c trouble ooo!!!!
Na like this the tori
take happen, one student for the lodge get big generator.. na im she use her
church mind connect 7rooms including her sef…before she connect them dem don
reach agreement say na 1litre each room go dey bring anytime wey dem wan buy
fuel…
as naija people wey we be trust us na we go gree cos na ofe we dey fine…according
to persin wey tell us this tori the persin tok say dem also agree say dem go
dey rotate the turn of people wey go dey buy d fuel them also gree. Buh after
some time na trust us na as we be human being we go like us our sense…we dey forget say
before Abraham there where men….na so oo trouble come begin to happen everyday
wahala, katakata sote peace no come dey the lodge…today person go vex say im no
dey connect again ee go comot ee light, 2morw another go say ee no get money to
contribute the owner go vex comot the pesin light. Anyday wey the pesin get the
money the student wey get the gen go connect am back.
Na like dis dem dey do
sote peace no dey the lodge again.
Recently dem gather money as usual na im the owner of the gen
tell some boys wey dey use thegen make them go buy the fuel because night don come and day don dark, na
im the boys say them no dey go “dat day
dem no follow contribute oo” say make the girl go out that night since na
she get the generator, the girl come vex come begin to para for dem she come
beg one of the boys wey no follow them connect make im help dem go buy 3litres
buh the boy come tell the babe say na 2litres im go buy na im the girl waka
commot oo thinking say maybe those boys go talk to that guy make im go buy 3 as
na their friend… instead make them beg make im buy 3 dem liv am im go buy two
(2)litres first dem no come on the gen
again the girl come vex go sleep..the next morning dem begin to para for the
girl dey tell the babe say dem go beat am on top her generator na so dem para
para come go disconnect their light come dey dicuss the babe for their group…
But trust girls now and trust Edo dem no dey carry last the girl na Edo babe…as
dem don para their own finish na im the girl start her own according to source
she say the babe para para sote she come tell them sey if dem make her vex na
only one phone call she go make and all of them go dissapear from school…she
threaten dem say weda dem think say na only dem be bad boys say if she call bad
boys for dem say dem no go fit stand dem..
LOL…na wa ooo make una
follow we laugh as one of our followers tell us this tori na laugh we just dey
laugh….
Na wa ooo na NEPA OR
PHCN WE GO BLAME FOR DIS KINE TIN…NA NEPA,ABI GENERATOR OWNER OR PEOPLE WEY
CONNECT DEY AT FAULT?
FOR MORE GISTS U CAN
REACH US HERE
MOBILE-+2348164247348
0 Comments